People think I'm in illuminati,or in a cult..I believe in Christianity-----Charly Boy Writes...No, I no dey suck human blood, I no be general overseer for illuminati, I no dey Ogboni or for cult, e don doooooooo. You People no go kill me with laugh for Naija. The way eyes dey red now, you go think say Apollo catch dem. Many guys dey write me say dem wan join illuminati, Cheai, there is Godoooo...I dey sure say the church buildings wey dey Nigeria pass our population. So called men of god wey dey town don dey assume the proportion of China. All looking for their next Mugu. Una no see me joor.
I have been queried a lot about my faith these days. Do I believe in God? Do I believe in Jesus? Do I pray and to who or what? I guess for many, they probably cannot wrap their minds around my spirituality. Am sure some people even think say I be native doctor as na only me dey take siesta inside coffin when I never die.
No vex, na my life and I dey rock-am anyhow, no homo. Some people dey form good Christians because dem wan go heaven, me I just dey denge dey pose because am living my own small heaven right here on this earth for this Nigeria. I no wan wait till I die. Even some of my Muslim brothers wey wan fast track dem own dey even do suicide bombing. Na only Naija Christains wey dey fear death yet dem all wan go heaven. Haba.